Your Health and Wellness Partner

Best Supplements for Mental Health (Pidgin)

Best Supplements for Mental Health (Pidgin)

"BEST SUPPLEMENTS FOR MENTAL HEALTH (Part 1) The brain dey use between 20 and 40% of the nutrients wen we dey consume daily. E dey draw energy from the calories for food and many important functions dey maintained by the minerals and vitamins wen dey inside our diet. Wetin e mean be say, wetin we eat and drink dey affect how well our brain dey function and the quality of our mental health. Supplements nor dey meant to replace necessary medication or food sources, instead dem dey act as support, and dey provide access to relevant minerals wen fit nor dey for our diet or e fit dey present but very low levels. Just as our body require balanced diet to dey physically healthy, our brains also require many essential nutrients to function properly. 3 essential supplements for optimal mental health: B Vitamins na 8 B vitamins dey : B1 (Thiamine), B2 (Riboflavin), B3 (Niacin), B5 (Pantothenic acid) B6 (Pyridoxine), B7 (Biotin), B9 (Folate), B12 (Cobalamin) and dem dey play many important roles for the body. Some of these roles include make dem regulate the stress-response and preventing burnout;make e produce brain chemicals like dopamine and serotonin; make e help hormone regulation, and make e help in the production and maintenance of DNA and other key proteins. Low levels of the B vitamins don dey linked to sleep disturbances, irritability, low energy, and mood disorders like anxiety and depression. B vitamins supplement fit help boost your energy and improve your memory. B-complex supplement na best as e contain all or most of the relevant B vitamins wen your body needs. Probiotics Healthy gut/stomach dey extremely essential to good mental health. The gastrointestinal tract(wen consist of the stomach and intestines)dey produces important chemicals wen dey help to regulate our mood and emotions. Diet wen dey rich in probiotics na good way to keep your belle in top form. Probiotics dey refer to substances wen dey maintain the healthy bacteria for our belle and other digestive structures. Dem dey act like fertilizer, wen go enable the growth of good microorganisms for the belle, wen go keep the GI tract and the nervous system healthy na em default mode be that. Probiotics dey obtained from various foods like kimchi, yoghurt,as well as from supplements. Some studies don show say probiotics fit help relieve mild symptoms of depression for some people. Zinc Zinc na important mental health supplement, wen dey widely known for em antidepressant properties. E dey influence the growth and maintain the nerve cells (neurons) for the brain. The brain need adequate number of neurons to adapt to change, stress, or traumatic situations. Low zinc levels for the body fit change our ability to cope, so e go dey increase the risk to develop depression. Foods like red meat and oyster contain large amount of zinc and pill supplements dey also available. You suppose take zinc supplements with food so eye nor go turn you. E dey important to note say too much zinc fit affect how other minerals go dey absorbed for the body. So,e important to see doctor before you start zinc supplements to determine how you suppose take am. Conclusion Supplements dey serve as gentle booster for good mental health. Dem fit help with reducing fatigue and tiredness, improving memory, and boosting mood. Before you start any supplements, please see doctor to make sure say you need the supplement, and say e nor go interfere with any medication wen you dey take, and e go give you advice on the dosage wen dey suitable for you"