Your Health and Wellness Partner

Wen Video Game Don Enter Body

Wen Video Game Don Enter Body

Africa nko dem no fit count how many people dey even play this game dem say for for here e don turn part of us say e don dey our body .

Every year na so so new game dey show face with better better ways to take enjoy am . So we sef go Sidon dey play all these games weda na for our phone o abi na video game o abi na for computer we go just relax dey entatain our sef with the game .

playing-video-game_t20_2Wo2NV-768x576-1
 

Many mama n papa sef don agree say game they help their pikin dem . The World Health Organization don come talk say e get the condition wen this game dey bring come n dem dey call am Gaming Disorder. Some pikin dem wen dey play game plus even you wen you don old wen still dey play game na all of una this condition fit worry .

See ehn person wen dey like to play game dey spend small time play game e fit be 3 hours for one full week .if na like so you dey play game e good the problem be say some people dey play every time every time .

WHO don come see say some people dey play game for 20hours inside the 24hours . Them come realize say yawa don dey playing game don turn to condition dem come call the condition “Gaming disorder”. So if them tell you say you get Gaming disorder make you know say playing of game don enter your body .

Make una no fear no be everybody wen dey play game this condition so go worry Na some people wen dey play game every time . For example pikin wen be say any chance e get for holiday na game e use am dey play but e still find chance to dey with him friends and family no fit get gaming disorder.

E get the kian way WHO take they know people when get this gaming disorder

  • the person wen dey play game go find out say them no dey fit control their desire to continue to dey play game every time .
  • The person go see say e no go fit stop to play game and this thing fit begin affect him real life . E fit begin late go work or school . 
    People wen get this disorder so instead make them commot with their friends or family them go prefer to Sidon dey play dia game . If you don Sidon one place from morning till night they play game body go begin weak you or eye fit begin pain you or you fit begin notice some kain signs of wetin oyibo people they call Carpal Tunnel.


 

WHO don say before we go fit say person get this gaming disorder make we don check well well say the person don clock out from family and friends dey follow this him game like say na government work and we go don dey watch am for up to 12 months .

People wen dey siddon play game weather na front of television o or na for phone dem no dey allow dia body work as e suppose work . E go come lead to different different sickness like heart attack, high blood pressure, obesity , poor blood flow , arthritis, cognitive impairment( e fit begin find am difficult to remember or confusion fit enter )

Make we put all these things for mind if person no dey mingle with other people bcos of game e fit affect am for brain . And e go make an easy for depression to worry am wen e decide to hid inside house dey play game .

How we go take prevent am

  • Make we begin time ourselves so we go know the time we wan spend dey play game make we come make sure say we follow the time we don plan to dey doesn’t on top game so we go get time for other things .
  • No be only game we go dey play every day we fit read book , go see our friends , do exercise e go help us lower our need to play game.
  • Anything wen go make you over play game run from am .


 

WHO don tell us say too much of game for make us get this gaming disorder and if you don get am e go cause serious kasala for your life .