Your Health and Wellness Partner

Underweight, like overweight, is bad for your health (Pidgin)

Underweight, like overweight, is bad for your health (Pidgin)


Under weight like overweight dey bad for your health


If doctors dey equipped with your weight and height details, dem go fit calculate wetin doctors dey call your Basic Metabolic Index or BMI for short.

Based on the simple BMI calculation, your weight fit be normal, under, over or terribly over the limits! Yes, the figures dey important, but wetin even more important na the health implication of the figures.



Based on your BMI wen dem calculate, your weight fit be;

• Within limits with BMI of 18.5 to 24.9 = normal weight

• Below the limits with BMI of less than 18.5 = underweight

• Beyond limits with BMI of 25.0 to 29.9 = overweight or

• Terribly beyond limits with a BMI 30.0 or higher = obese/obesity!



All caring mothers dey remember the weight charts and dem dey fear make dem tell dem say the graph of dia baby weight dey move downward small small.

But, even mothers dey forget to check on dia weight as dem dey grow older. Most mothers know say worms fit make dia pikin sick and underweight.



Well, worms dey important, but being underweight fit result from several factors like;



• Worm infestation

• Dem nor dey feel like to chop from appetite-decreasing diseases,

• Dem nor dey feel like to chop from depression or anxiety

• Obsessive-compulsive desire to lose weight

• Burning too much from frequent physical activity or high metabolism

• No dey keep wetin you dey eat from long-term vomiting

• Family history of underweight



Which health problems fit come wen you dey underweight?

Even though say nor be everybody wen dey underweight dey affected, to dey underweight dey come with many health problems like:

• Malnutrition wen dey result in growth and development retardation, especially among young people

• Vitamin D and calcium deficiency with increased risk of osteoporosis (brittle bones)

• Immune function deficiencies

• Greater likelihood to develop complications from surgery

• Anemia

• Irregular menstruation



Wetin you fit do?

This one go depend on the cause of your underweight;

• Good old practice of regular deworming for children and adults

• Get diagnosis from qualified doctor

• Resolve underlying mental conditions like anorexia, bulimia, depression and anxiety go help improve intake and lead to weight gain

• Get treatment for high metabolism, diabetes and vomiting- associated diseases

• Regulate physical activity

• If family history dey present, seek medical help on measures wen fit help



Take-home message: Underweight, Like Overweight, dey Bad for Your Health, but if you seek medical attention e fit easily end your pains.