Your Health and Wellness Partner

"Strengthen your mind to overcome caregiver burnout (Pidgin)"

"Strengthen your mind to overcome  caregiver burnout (Pidgin)"

Strengthen Your Mind to Overcome Caregiver Burnout

Caregiver dey provide help to person wen dem get personal relationship with like family member or friend. Dem go help to baff , chop, giv dem medicine , and even medical tasks like make dem set up feeding tubes. 
Caregiving dey be intimate event, but e dey also dey very time-consuming and dey present challenges wen fit dey mentally, emotionally, and physically draining.

Caregiver burnout na state of complete physical, mental, and emotional exhaustion, and attitude changes and hopelessness dey follow am waka come . 
Caregivers wen dey experience burnout fit dey feel depressed, anxious, irritable, overwhelmed, and fit neglect their own health and wellbeing. 


To cope with the mental and emotional stress wen caregiving dey give the caregiver, you suppose take steps to boost your mental strength.

Here na some tips to try:

Acknowledge your efforts
Sometimes as caregiver you fit nor hear thankl you sef . E fit appear easy to other people so dem go overlook your effort, or dem fit just feel say na your responsibility.
You dey work around the clock without any external praise , and this one fit affect your motivation to do more. To counter this one you go start to tell yourself welldone for your efforts. 
Keep it in mind that you dey do tough job and you dey do am well!
Plus, find ways to reward yourself.


Ask for help
Caregiving na serious responsibility and if you dey do am alone without help or break e fit result to burnout.
You fit start to dey talk to other family members about the things wen you need help with. This one fit be like maybe you need person wen you go dey send message , or weda na person wen go dey pay for external care services, or person wen go show up to help for part of the day, so you fit take a break. 

Look for another way to improve the situation, like make you employ nurse wen go come provide home services. 
You fit also see mental health professional to help you work through your emotions and develop healthy coping strategies. 

Take care of your health
To care for another person , you must dey healthy.
Research don show say mental and physical health they mix together . If your body dey pain you, you go dey tired all the time, and you go always dey fall sick because of stress, you dey unlikely to feel happy, capable of handling challenges, and positive about life. 
Make sure say you schedule regular doctor visits to make sure say you dey in top form. 

You go need to dey do regular exercise to fight tiredness , boost your energy, lift your mood, and relieve stress.
Eat three times a day and try to make sure say you dey eat balanced diet. Keep time aside for your self-care.

Use your time to do something just for yourself. You fit do your hair, get full body scrub, siddon for the sun, or talk a walk. Finally, make sure say you get as much sleep as possible. Take care of yourself o na necessity, nor be luxury.

Conclusion
Caregiver burnout dey real. E dey important say caregivers recognize the signs of burnout and take steps to counter am quick. E dey even better to dey prevent am. If you know any caregiver, please take steps to look out for them, as they fit nor recognize when dem dey burned out.