You go begin hear ” but I drink postinor” “I drink salt and water “
Aunty wen no wise ego better make you listen to wetin I carry some make you for fit avoid shame and disgrace.
• Merecine wen women dey use make dem for not get belle after them DO without rubber na him them dey call Emergency contraceptive pills (ECPs) you fit still call am Morning after pills.
• The ECPs wen dey available for Africa na Postinor 2 , Plan B One-step and My Way)
• Dis merecine dey work well well to help women make belle for no enter but for am to do e work well go depend on the time wen you take the merecine after you DO without rubber .
Wetin be this merecine?
This merecine dey common well well for women wen don reach age to take get belle for the world .
This morning after pills not be abortion merecine na to prevent belle . Them do d merecine with progestin(na hormone wen dey happen naturally for woman body and e get role ro play for woman menstrual cycle and pregnancy)
The merecine dey work well?
E dey most effective wen you take am 72 hours after you DO without rubber (unprotected sex) d effectiveness go begin reduce fast fast once e fon pass 72 hours .
You go need take am quick so e go fit work well for you . Na only for emergency you suppose use am o no be everyday merecine to take prevent belle .
You fit don hear some women complain say dem get belle even tho say dem take merecine .
Make I yarn you why e fit be like that .
▪︎ if the woman ovulate before she drink the merecine: if woman ovulation start before she drink am the merecine fit no work. Another thing ehn if she go DO again after she don take the merecine for the same cycle the merecine fit no work .
▪︎ E get some kind drugs wen fit make the merecine no work
- Merecine wen dem take dey treat seizures/convulsions (Phenytoin)
- Merecine wen dem take dey treat tuberculosis/leprosy (Rifampicin)
- Merecine wen dem take dey treat fungal infection/ ringworm (Griseofulvin )
- Merecine wen dem take dey treat depression (Barbiturates)
Ego better make you ask your doctor weda you fit take Emergency contraceptive pills to avoid stories that touch.
▪︎ the kind body wen the woman get fit no allow the merecine work . If the woman fat don too much for body (obesity) she go need follow her doctor talk . Some experts don say them recommend Copper IUD for women wen get excess fat for body .
If you vomit two or three hours after you don drink the merecine you fo need take another one .
This merecine dey safe?
Most of the ECPs dey safe wen you use am the way them say make you use am and wen you no turn am to everyday merecine.
Side effect be say eye fit turn you small or make you vomit . Some women say dem dey get small bleeding after them drink am .
Women wen get heart disease or blood clot or woman wen dey at risk to get stroke no need take Emergency contraceptive pills.
Make una know say
▪︎ ECPs dey prevent belle but e no dey prevent Sexually transmitted diseases.
▪︎ over use ECPs get him own wahala o
Visit your doctor make una discuss the safe birth control method wen go good for you.
MO don yarn una as e dey go to avoid stories that touch