Your Health and Wellness Partner

Memory loss in young adults: Causes and Solutions (Pidgin)

Memory loss in young adults: Causes and Solutions (Pidgin)

Memory loss in young adults : causes and solution.

Memory slips fit happen to  young adults just as e dey happen to older adults. Older adults dey usually dey worried abt dia brain health and say eventually dia memory nor go sharp the way wen e suppose be, but younger adults noe dey concerned with dis matter. Many times, say dem dey  forgetful dey seen as wetin nor dey important but for some cases, e fit begin bring worry.    

If you feel like say you dey always forget important information,  some potential causes na:    

Depression :  
Research has show say depression na the strongest risk factor for memory loss across all age groups. Depression na psychological disorder wen dey bring  intense feeling of sadness & hopelessness,loss of pleasure for things or events wen dem been dey always enjoy, and suicidal thoughts. Depression dey also results in forgetfulness, difficulty concentrating, and clinical state known as pseudodementia.    
Pseudodementia na clinical state where person with depression get symptoms wen dey similar to dementia. Some of these symptoms na slurred speech, forgetting people and things, and delayed response to external stimuli.  

Solution: for this one, memory problems go dey resolved when depression don dey treated.  


Poor sleep  

Sleep dey essential for the brain to function well. if you dey get less dan the amount of sleep wen dey required e fit affect your memory. This na because sleep wen nor reach dey lead to difficulty concentrating, mood swings, blurry vision, and headaches. E dey hard to remember information if you nor fit concentrate on am or if your head dey pound. When you nor sleep reach, the only thing wen go dey your mind na sleep and everything else go fade into the background.  

Solution: make sure say you get at least 6-8 hours of sleep every night to make sure say you dey well-rested.    


Certain Medications  

Your memory fit dey affected by some prescription medication. These drugs fit cause memory problems for both young and old people. If you dey take any of these medications, e fit be the reason for your memory loss:    

Anticholinergics: merecine wen dey prescribed to manage gastrointestinal problems, muscle spasms, and pulmonary diseases.  

Anti-depressants:  merecine wen dey prescribed for the treatment of depression and for some cases, migraines.    

Anti-hypertensive drugs: merecine wen dey prescribed to manage hypertension    

Tranquillizers: merecine wen dey prescribed for mood disorders like anxiety and depression, and for sleep disorders like insomnia. 
 

Solution : if you notice say your merecine dey affect your memory, ask your doctor to give you anoda one.    


Stress and anxiety  

Serious stress and anxiety dey cause memory problems for the same way wen sleep dey cause am. Dem go prevent you from concentrating one the necessary information and locking the information for your long-term memory. Information for short-term memory dey quickly loss if e nor dey properly stored. Plus, stress and anxiety fit affect your attention and disturb the formation of new memories and disturb make you nor remember the stored memories.    

Solution:    

For stress, try make you dey take breaks and use stress management tips for your daily life. Avoid multitasking, share tasks wella, and ask for help wen you need am. 
  
For anxiety: you fit need to seek professional help, your doctor fit recommend therapy, medication, or coping skills and techniques.    
 

Conclusion  

Many people deyignore memory problems for dia youth cos dem dey think say na only old pple fit experience memory loss. Memory problems for young adults fit dey caused by many factors like sleep, depression and anxiety, but dem fit dey resolved if you manage wetin cause am. Nor be only the things wen we don talk abt, some oda tips dey like healthy diet, regular exercise, and brain exercises all dese go dey  helpful to maintain your memory.