Your Health and Wellness Partner

Jaundice in a newborn (Pidgin)

Jaundice in a newborn (Pidgin)

WHY JAUNDICE DEY COMMON WITH NEWBORNS?
Jaundice na common problem with newborns. E dey happen when the yellow pigment for their skin, eyes and urine release from their cells into their blood stream. Na im dey cause the yellowish appearance.

Wetin dey cause am na plenty bilirubin, one yellowish pigment wey dey the bloodstream.

One reason why jaundice dey happen for newborn na because their liver fit no remove all the plenty bilirubin. Na because their liver never still mature.

Most times, e dey go on im own. But once you notice yellowness for your pikin face, abeg talk to your doctor.