Your Health and Wellness Partner

"Can healthy eating turn dangerous? (pidgin)"

"Can healthy eating turn dangerous?  (pidgin)"

Can Healthy Eating Turn Dangerous? 
  
Na Steven Bratman create the term Orthorexia, e be medical doctor from California, in 1996. Orthorexia na eating disorder were fixation or obsession dey with healthy and proper eating wen go often results to negative consequences. The person nor get interest to lose weight, e just wan dey healthy. 
  
People with orthorexia believe say dia health fit dey maintained and improved if dem eat specific kind of foods.  
Dem go come create diets wen contain only foods wen dem consider say dem dey pure or healthy enough. For example , person with orthorexia fit get diet wen consist only of green vegetables and fruit juice, or diet wen consists only of meat and other animal proteins. 
Awareness about orthorexia dey increase globally, but na still uncommon disorder.  

Here na important things you suppose know about this eating disorder: 
  
Wetin dey cause orthorexia? any risk factor dey ?  

Orthorexia dey usually start as genuine concern for person health and well-being, but this concern go quickly pass be careful. Nor be say e get any singular cause, but some risk factors dey contribute to the development of this disorder. Dem include issues with identity, body image or self-worth, to dey experience prolonged sickness , difficulties sef go dey for person social, emotional or school/work life, spiritual purposes, and need for control over your life. 

warning signs and symptoms. 
Like many disorders, orthorexia get some signs and symptoms wen you go need watch out for. Dem include : 

● wen d way you dey worry about the health value and quality of food don Increase 

● wen you don begin dey classify some foods as safe, pure, or healthy and na only dose food you don begin dey eat 

● wen you don begin dey lose weight seriously and you get malnutrition 

● wen you don begin dey dedicate too much periods of time to food planning and preparation 

● wen you begin avoid social events or begin worry about d event days before the event due to concerns about the food dem go serve.  

● wen you begin avoid food wen another person make as well as food wen dem serve for restaurant and eateries. 

● wen you stop entire food groups from your diet. 

● wen you get serious urge to check the nutrition labels of packaged foods. 

● wen you begin get anxiety when safe, pure, or healthy foods nor dey available. 

● wen you begin dey fear to sick because you chop unhealthy foods 

● wen shame and guilt begin dey catch you wen you chop food wen dey outside the pure/healthy category . 

● wen you begin get unusual interest for wetin another person dey chop and weda e dey healthy . 
  
Orthorexia fit result to terrible health consequences 
Orthorexia fit affect both mental and physical health negatively, and some of dese consequences fit even be permanent.   

Physical health effects include reduced immunity, amenorrhea (absence of menstrual periods), infertility, heart disease, and malnutrition. 

Mental health effects include social isolation, anxiety, cognitive impairments, and emotional instability. Other disorders, like obsessive-compulsive disorder and depression, fit also happen alongside orthorexia. 
  
  
Dem fit treat or manage Orthorexia 
Before dem go put treatment or intervention plan in place, doctor or mental health professional must give formal diagnosis of orthorexia. After diagnosis, many types of treatment dey wen dem fit recommend. 

Some of them na behaviour therapy and modification, cognitive reframing, cognitive restructuring, exposure therapy, and mindfulness training. 

Conclusion 
Orthorexia dey involve extreme healthy eating habits wen dey affect the well-being of the person. Even though say dese habits fit appear healthy for the surface, dem dey lead to negative physical and mental health effects. If you suspect say your eating habits fit dey move go this direction, abeg see doctor or mental health professional.