How To Take Tackle abuse inside relationships
To dey deal with abusive relationship nor dey eva easy and to decide wetin to do fit dey difficult for the victim. Abuse dey use many forms take show: verbal, sexual, emotional, physical or all of dem.
You fit dey abusive relationship if your partner:
.Dey physically harm you like say make e dey hit you or shove you or threaten say e go harm you if you leave am
.Dey sexually violent: dey force you into sexual acts
.Dey controlling: E dey try to control your dressing, your friendships, your online activity, and your social life
.Dey use threats and manipulations to make you stay for the relationship
.Dey verbally abusive (even on social media)
.Dey very suspicious and jealous
.If e lack empathy and dey constantly blame you and oda pple for dia actions.
.If e dey punish you with silent treatment, dey withholding things, dy vex or dey do things wen e knw say go hurt you
.If e dey get sudden mood swings like say one minute e dey do loving you and the next minute e don dey vex for you
Na small samll abusive behavior take dey start small before e go pass be careful. Most times, the victim go dey blame dia self for dia partner actions, believing say na dia action na em fit dey trigger the abuse.
If you find yourself for any abusive relationship, e get few things wen you fit do:
Leave
Dis na the first and most obvious advice if you dey deal with abusive relationship. If you get supportive family or friends to stay with, leave your abuser as soon as possible. Explain the situation to dem, so dem nor go let your abuser came inside dis houses. If this option nor dey available, do your research; find domestic violence shelters where you fit stay. These shelters dey open to abused victims and dia children and dia location dey confidential to make sure say the person dey safe. These shelters fit also help you access legal help, financial aid, support groups, employment opportunities, and trauma therapy.
Stop to dey believe say dem go change
The idea say dia action na temporary and say dem go soon change nor be true. For most cases, the abuse go continue and fit end in death. Abuse na about power over another person; abusers dey rarely take responsibility for dia actions or accept dia faults. While change in behavior fit happen, e go take time, therapy and make the abuser take responsibility for dia behavior instead make dem dey blame you/others.
Shine ya eye for the red flags
Usually, signs and tells wen your abuser go display before eveything burst many. Learn all the signs and tells make you use dem as clues to protect yourself. Once you notice these signs, find way to alele, hide o nor come outside or ask for help.
Get secret code
E dey very helpful to get signal, phrase, sentence or word wen go indicate say you dey in danger. Share this code with friends or neighbors wen you trust, your children and family members too. Also,make you get plan of action in place wen go dey carried out after you use the code. Make sure say you cram emergency contacts like police, violence helplines, friends, etc. If you get children , make them memorize these numbers too.
Abuse na difficult and traumatizing thing to go through, even after you leave your abuser, the scars go still remain. Trauma therapy fit help you deal with the stress from the relationship. plus,if you dey self confident and learn ways to build your self-esteem e go help you avoid similar situations for future relationships. Remember to look out for red flags for the begining of the relationship before you dey too attached.