Your Health and Wellness Partner

Obesity and Fertility (Pidgin)

Obesity and Fertility (Pidgin)


Obesity & Fertility


You know say your body weight fit affect your chances to get belle ?

Some ways dey wen obesity fit take affect fertility for both men and women: from say e prevent ovulation to say e reduce sperm movement. 

But wait first, wetin be obesity?

To measure Obesity na body mass index (BMI) dem dey use. To calculate BMI dem go divide weight (in kilograms) by height squared (in meters), (kg/m2). Na with this formula dem take dey consider people wen get BMI wen high pass or equal to 30 say dem dey obese.

Research don show say BMI between 20 and 25 (dey considered normal weight) dey make am easy to get belle. Obesity dey affect fertility for many ways.

High body weight dey increase the chances of say woman nor ovulate. E usually dey caused by insulin resistance wen dey triggered by obesity and even increased level of testosterone, the male reproductive hormone. For these women, fertility and regular ovulation fit dey restored after she lose weight well well.

Obesity dey also reduce your chances say you respond well to fertility treatments like for vitro fertilization (IVF). This one na bcos IVF procedures like embryo transfer and egg retrieval dey more challenging to perform wen the person dey overweight. Plus, wen the procedures dey successful, the chances of successful pregnancy dey lower when the person dey overweight.

Men wen dey overweight get higher chances to dey presented with low sperm counts. E dey happen because of higher body temperatures for overweight men, especially around the scrotum. Plus, obesity fit result to hormonal imbalances like higher oestrogen levels and lower testosterone levels. This one, fit in turn, cause low sperm count and quality.

Obesity get strong link to complications during pregnancy. Overweight women dey at higher risk for pregnancy-induced hypertension and diabetes. If you dey overweight e dey also increase the likelihood of miscarriages for several reasons like changes in hormone levels, low quality eggs, and inability for the fertilized egg to dey implanted into the womb.

CONCLUSION

Obesity fit contribute to infertility for both men and women. Overweight couples wen dey try to conceive suppose get weight-loss plan together. E don dey recommended say fertility treatments suppose start after the couple reduce weight to increase the chances of successful pregnancy.