Your Health and Wellness Partner

Combating Burnout in the Workplace (Pidgin)

Combating Burnout in the Workplace (Pidgin)



Job burnout na situation where person go experience physical and emotional tiredness for work. Na doubt about work dey accompany am, health issues like headache and stomach problem, reduced productivity, and loss of satisfaction for person achievement.


Some things teen person fit do to fight burnout: 

Ask for help :

This na the first thing to do when you feel say the work or life problems don choke . 

Follow your supervisor and co-workers talk make you explain how you dey feel. If you be supervisor or team leader, share work and do collabo with oda leaders any time wen e dey possible. 

Help fit also come from therapist or counselor wen go help you identify areas wen problem dey and e go provide you with better coping strategies. 


Find your purpose:

your work dey meaningful? E dey make you happy or e fall in line with your values? 

You dey realize the goals wen you set for yourself? If you dey work for where you dey stagnant or your focus na for only money wen dem dey pay you , e fit cause deep stress. 

You get to find out wetin you wan do, how e go gel with your values, and the goals wen you wan accomplish. If you dey work with purpose e go fit help you for the fight against burnout. 


Conduct a career/job analysis:

The first thing be say you go ask your self weda you think say you dey the right career field? 

You dey work for role wen you love? If the ansa na no,den try some career assessments make you take steps to move go career role wen you dey actually enjoy. 
If you love your job, analyze the roles wen dey required for work overload. Find out which of the tasks wen you dey do wen you need drop. 
Work overload for dey very stressful and go lead to burnout. You go need to speak to your Oga or supervisor about your workload and how e dey affect your mental health.


Take a break: 
The best way to take reset na to take break from work. Make sure say you leave work for work, nor answer emails or calls. If you commot from the stressful work environment e go help you clearly identify the issues you get for work: Na your job gan gan be the stress? You think say you need new career path? Abi na your workload? If you take break e go help you look your work with fresh eyes and e go help you make the right decision. 


Find a way to relax: 

One of the best ways to de-stress and to commot your mind from work na to find relaxing hobbies or activities. Try yoga, painting, cooking, dancing, gaming, meditating, etc. options dey many for you to explore. Regular exercise dey also great for stress management. Exercising go help you with better sleep, e go increases your energy and general wellbeing. 

Burnout na severe form of work stress and e dey get terrible impact on employees and the organization as a whole. Organizations suppose take steps to make sure say employees nor reach dia breaking point and say help dey available wen employees reach breaking point.