Shey Bluetooth Devices Wen You Fit Wear Dey Harmful To The Body?
As 1980s dey end, Ericsson mobile engineers beegin consider the idea of say dem go develop short link radio technology wen go serve as alternative to wired options.
Dem later nickname the technology Bluetooth and dem make am dey able to exchange data between compatible fixed and mobile devices over short distance through radio waves.
The idea come later dey concentrated on top developing Bluetooth headsets by both Ericsson and IBM, vision wen dem realize for the development of award-winning Bluetooth wireless headset for 1999.
Wetin inform the health concern about Bluetooth wearable devices?
As e dey be for almost all the cases, we go celebrate the technology first, before health concern go come later.
Bluetooth wearable devices dey transmit data over short distance and na radio waves e dey use. Na here the concern take arise-- the radio waves. The question be say, shey radio waves dey harmful to our health?
Radio waves and your health, any concerns dey?
Radio waves don find useful applications tey tey before Bluetooth wearable devices show face. We don use radio waves with medical procedures like diathermy, deep heat and other applications.
The health concerns about radio waves dey minimal because dem dey possess lower energy dan some oda types on non-ionizing radiations-- dose radiations wen nor dey induce harmful body changes.
Radio waves dey the class of visible light, infrared, and ultraviolet rays, and because of the low energy of the radio waves wen dey involved for the Bluetooth technology, Fear nor too dey regarding dia potential adverse health effects. In fact, the technology don expand to Bluetooth speakers and sound systems. E don become part of modern lifestyle for person to interact with one Bluetooth device or another.
Even with dese attributes, health experts still dey keep radio waves under the radar because dia level of energy dey higher dan the extremely low-frequency radiation. Na the reason, wen make concerns dey say radio waves fit produce heat and cause body tissue make dem damage if we give dem enough time and large enough absorptions into the body.
So, dese wearable Bluetooth headsets dey discharge radio waves?
Yes, for dem to transmit data dem go use short-wavelength radio waves with frequency wen dey range between 2.4 and 2.485 GHz. We dey use Bluetooth devices for so many ways. Even medicine don enjoy wide range of Bluetooth-powered so e dey make the thought of harm difficult to believe. After all, e dey obvious say all dese na low energy radiations.
Even with dese assurances, scientists nor dey rest, dem dey continue to examine possible links between wearable Bluetooth devices and dangerous health occurrences. Apart from dis most authorities, including the Food and Drug Administration of the USA, still dey hold the belief say Bluetooth devices dey harmless to human beings. E too early to say how dis go turn out, but, constant vigilance and moderation na the key!
Take-home message: Health authorities dey consider wearable Bluetooth devices say e dey harmless to human beings; however, as scientists dey continue dia work. E dey wise to shine your eye, limit the way wen you dey expose yourself to wearable Bluetooth devices.