Your Health and Wellness Partner

"Seizure disorders in your infant (Pidgin)"

"Seizure disorders in your infant  (Pidgin)"

Seizure disorder in infants 


infant na small pikin wen dey between the age of 1-18 months. The challenges of infant dey signify important part for the development of the pikin. 

This na because actions and inactions for dis period get long term effects on the health and well-being of the pikin. 
One of the common problems wen dey happen to infants and young children na seizure disorders.   

Wetin be seizures disorders?   
Seizures na result of disorganized or overfiring of brain cells wen dey happen bcos of various forms of physical display like falling down, rapid, jerky movements, and sudden loss of consciousness.   

Seizures dey common for infants and dey happen bcos of plenty causes. Structural causes due to direct assault for the brain e fit be bcos of lack of oxygen to the brain during traumatic or prolonged labor and delivery.This one usually dey happen wen dem born pikin with some damage to the brain. E fit make the infant get seizure disorders.    

Other causes of seizures for infants na if dem get disturbed chemical balance for the blood, low or high levels of glucose, potassium, calcium, or magnesium. Infections of the brain fit also result to seizures for infants. Inheriting some medical conditions or genetic disorders wen dey put children at risk to get seizures fit also cause seizures.   


How seizures dey show ?   
Subtle seizure – This na the commonest type of seizures for newborns. These seizures e nor dey usually obvious to Ete wen nor get training . 

E dey show like say d pikin dey smack em mouth, small small movements of the eyelids and lips, changes for breathing patterns, bicycle movements of dia legs, brief jerks or episodes wen be say dia body and limbs go stiff. 

Dem fit nor dey alert as dem dey usually dey . E fit dey difficult to attract dia attention and their eyes fit nor focus properly.    


Clonic seizure – Dis one dey manifest by say the baby go get jerking or stiffening of arm or leg wen fit involve the two arms and legs for different times.    


Myoclonic seizure – During this type of seizures, the baby whole upper body fit suddenly jerk forward. Or the two legs fit jerk up go dia stomach, dia knees go come bend .   


Tonic seizure – d way wen dis seizure dey manifest na say d baby body go stiffening and dia eyes or head fit turn go one side.   

 
Wetin you go do if you suspect say your infant fit get seizure?   
Some events go make you suspect seizure and the events suppose make you quick carry your pikin go hospital to see specialist. These signs include:   
1. Any changes for your baby behaviour.    
2. All the seizures dey look the same, and dey last the same amount of time.   
3. The seizures dey happen while the baby dey awake or dey sleep, or the two of them.   
4. The seizures dey caused by changes for the baby posture, or wen dem dey do different things.   
5. The seizures go interfere with, or stop, the baby activities, like feeding.   
6. You fit help the specialist, you go record any behaviour changes for your mobile phone.   

 
The specialist fit arrange for some tests wen go help am make diagnosis and determine the likely cause of the seizures.    

 
Conclusion   
Seizure disorders for infants, if e dey managed well, e fit become thing of the past. Wetin dey important na say the parents quick notice the abnormalities and present am to a specialist as soon as possible.